SHARE

Bad Persin Lyrics by Erigga

SHARE

Erigga Lyrics

'Bad Persin' is Erigga's latest music release, read the in a few scrolls lyrics and sing along.

Bad Persin Lyrics by Erigga
Bad Persin Cover

PLAY & LISTEN TO: Bad Persin by Erigga

Erigga - Bad Persin Lyrics

Intro
Erigga paper boi
Omo I no get power to argue again oh
If you say white na black I no go follow you quarrel abeg

Verse 1
Na who friends never show dey carry squad for head
'Cause Me na shoulder if e tire me I put am down
Move ahead my blood inside your cartel
Another cartel dey when fit poison your Martel
To change am like bureau de change no dey hard dem dolls
You forget say when sugar finish every ant dey lost
Na Inside squad dem sell Jesus deny am thrice
No be shoot bird mama fly u gats hold your blurkus
E don tay dem see you better pass this craze don cum again
Na who get money be their blood oh(I swear)
No put body if dem no call you, dey respect yourself
No go dey give too many Fs, some kind times dey deff the blog oh
You see that time when you find make we sitdown crack gist
Dey talk about “remember when” I don mathematics
Dey calculate how much we fit make onto say we sharp
Money go lap oko relax no forget your blood oh

Chorus
The day you no give them money you be bad persin
They call your number you pick am you be bad persin
no go dey follow dem argue oh, I be bad persin
Na you good take award we don leave am for you
99 good plus one bad equals to bad persin
You no dey show your people love no I be bad persin
area no get memory do the one you fit do
You like you kill your self them for still say u be bad persin

Verse 2
Come outside fresh air blow igbo for beach
They think about money brother happiness ain’t cheap
No carry jump anyhow dey use your number 2
Life no be first to reach there, make billing no wonjor you
Leave all those write up dem post their character too bad
Their  mind set need to change nobody owe dem jack
Nothing concern us we go tell you who dey fear you guy
The big goat who you dey fear dey fear me die
Friendship when no dey go calculator na bad friendship
When no good for your inner peace any how friendship
I no kwokwo be better person  no need to form
Or see your call run who be blood wah you run
Maybe na all backstabbing dey make my heart dey bleed
All your conscience out no be say I no hear you greet
It’s had to tell who really love you when you in the streets
Many wan kill you finish you put you inside six feet deep

Chorus
The day you no give them money you be bad persin
They call your number you pick am you be bad persin
no go dey follow dem argue oh, I be bad persin
Na dem good take award we don leave am for dem
99 good plus one bad equals to bad persin
You no go show your people love no I be bad persin
Area no get memory do the one you fit do
You like you kill your self them for still say u be bad persin

Verse 3
God no come from your villlage oga comport your self
Na yaba left you dey go so,protect your mental health
Make you for no craze this lifestyle fit injure you
Internet no send tomorrow dem go disco you
Club when you shutdown for nite dey open today
Na brain be jazz man keep money 'cause tomorrow day
The girls no dey go anywhere when body full u date
School no be scam no mind them na just excuse to wait
Wait  when u jam dem Elon musk watin una yan
Okpako die butu rest, which club u wan take see am
Money finish eye clear phone no dey ring again
Story don spread olosho no dey pick again
Life no hard all na you say you wan must rich
So put in work no complain confirmations sweet
Multiple streams of income alert dey ring like drum
No eat future sapa fit waylaid you with gun runnnnnn

Outro
Erigga that one bad person
When no dey pick e brother call bad persin
As I no vote for ur person now I be bad persIn
Na you Goood  take award we don leave am for you

Liked 'Bad Persin' Lyrics by Erigga? Read Other Latest Music Lyrics Here

Get Fresh updates as they drop via Twitter and Facebook

Related

ADVERTISEMENT