Heavenly Race Lyrics by Boy Spyce & Ajebo Hustlers

SHARE

Boy Spyce and Ajebo Hustlers Lyrics

With soulful melodies and thought-provoking lyrics, Heavenly Race by Boy Spyce featuring Ajebo Hustlers reflects on faith, hustle, personal growth, and the realities of life’s struggles. The song highlights the pursuit of success, the pressure of survival, hypocrisy in society, and the importance of staying true to oneself despite challenges and temptations. Through emotional storytelling and uplifting Afro-fusion sounds, Heavenly Race delivers an inspiring message about perseverance, accountability, and running life’s journey with patience, honesty, and determination.

Red Pill EP Cover Art

Boy Spyce & Ajebo Hustlers - Heavenly Race Lyrics

Dangote still dey pray to God e make e bless am
Person wey get keke dey pray for venza
And the person wey dey trek reach Ikeja
Still dey pray for money make he see Danfo to enter
Everybody wan dey plug who go be the socket
You go see the cripple walk
When dem blow the trumpet
Whether nah heaven or hell, oh you know for your conscience

Everyday you pray for grace
But you no change your evil ways
Go marching in oh when the saints
Only you run your heavenly race
(Maza maza, maza maza oh)
Fast and pray for like seventy days
(Father father, father father oh)
Na there you go see say bribe no dey for the heavenly race
(Say e no dey, say e no dey oh)
Bribe no dey for the heavenly gate
Fast and pray for like seventy days
Only you run your heavenly race

Abeg
Abeg make you hold am there...
Bebelube, hypocrisy... nah their whole idea.
Dem go chook mouth... Omo me for all I care
I Dey stack up my rabba, I Dey get am clear
Wetin you talk no be wetin you do
Dem wey set the rules na them wey break the rules...
Same thing you criticize
Na the thing wey you Dey do
Be like, inside your head, you Dey loose some screws
I don Dey this journey
E don tey!
Smart enough to know not to go the wrong way aiii
On a daily
I'm blessed I complain
Cause I can have enough and still want more again ahhh...

Everyday you pray for grace
But you no change your evil ways
Go marching in oh when the saints
Only you run your heavenly race
(Maza maza, maza maza oh)
Fast and pray for like seventy days
(Father father, father father oh)
Na there you go see say bribe no dey for the heavenly race
(Say e no dey, say e no dey oh)
Bribe no dey for the heavenly gate
Fast and pray for like seventy days
Only you run your heavenly race

KPOS!
I no go lie for you my brother pray for grace
Wetin some people take days to get e dey some years
The life sef e no balance on a day to day
If your papa no guide, you go watch your future fade away
If you're from where I'm from then life dey win two zero
Them go take you for a fool if you dey too mellow hmm
But e no get as e wan be
There's a pay day for every hustler this one no be say them say
I dey keep my pride for house as I dey on my grind
You no go understand nah me know wetin Dey find
No be me go tell you You suppose don know from time
Who dey pass through wonders no go ever see the signs

Everyday you pray for grace
But you no change your evil ways
Go marching in oh when the saints
Only you run your heavenly race
(Maza maza, maza maza oh)
Fast and pray for like seventy days
(Father father, father father oh)
Na there you go see say bribe no dey for the heavenly race
(Say e no dey, say e no dey oh)
Bribe no dey for the heavenly gate
Fast and pray for like seventy days
Only you run your heavenly race

Check Lyrics of latest songs here, and get fresh updates as they drop via X and Facebook

Related